EPISODE 7
TORY TORY
Make i first dedicate one worship song to God, make i thank hIm for my life. If you dey read this and you get the song for phone abeg play am as you dey read dey go.
Title: If he no be God
Artist: Reminisce ft Mr Eazi.
Welcome back. As i dey look my life so, i really thank God o, and i also thank the winch and ancestors wey dey my life wey don use piriton. I pray say dem no go wake up again o.
I remember when i just be normal person wey just dey hustle for street, dey go school, dey pray say make i find better job after graduation. But then things in every situation or anything that happens always find the positive part.
It all started with Blackberry then, same blackberry that made lot of girls lose their virginity and glory; i was exploring all the apps on my phone then i saw Twitter. It was all about 2go that year, 2010 or so, then i wanted to be different and did twitter.
Na so that boy wey dey appear for my dream that time (datzmenoni) followed me and my glory went from red star (novice) to Purple (amatuer). Naso he tell me about online PR, I been dey think say na arm robbery sef, because the way him talk am ehn, na like say you wan do money ritual ni.
My winch people still dey active that time, dem never enter menopause, na so i yarn am say i no do. But thank God for God, i later reason am say make i do, free job wan first run me down then a big job came knocking in 2014.
The rest na tory now coz where my name don reach sef, me sef i no sabi…
datzmenoni i thank you, if you no come meet me that time, where i for dey. And no dey do gragra for me again o…
Till next time. My name na Butosh. For every situation, Always find the POSITIVE part….
Lol
So Yinka (@datzmenoni) sef feature today My guy don blow
butt-hush
butt-hush
I will win today