EPISODE 4
Una welcome back to my tory. i for give you previously on chronicles of Butosh, but time no dey for that one. I get babe wey i wan go visit for house and she need my attention badly.
You dey wonder say, wetin i dey talk? No dey surprised padi mi, na my area of expertise be that. if you never sabi say my name BUTOSH mean something, make i quiqui yarn you.
Butosh simply means Butt Hush.
hmm.
I dey feel wetin you dey think. Ehn na normal Butt . Butt as in yansh. I no dey do all this yeye yeye strech mark butt wey we dey see today. Na those ones wey dem photoshop for real life na im i want.
If you wan come my side. Abeg do make up for your yansh when you dey do for your face i no like whahala for myself.
No blame me na Abdulala cuase Konji wahala. Time don dey go the babe don dey wait me.