WHY ME?
The Association of Boyfriends
In the world
Ladies Lounge
in the world
Dear babes,
LETTER OF COMPLAINT
The level wey everything don reach like this, girls matter don tire me. I no understand why Ladies dey only think say dem smart say dem fit do anything to guys wey sha don love up.
I miss my period, I no see my period, my period hasn’t surfaced o. Abeg where you put am coz i no understand. Shay na only me this thing dey happen to abi shay he dey happen to other guys, abeg epp me answer.
Na the third time be this wey babe go try wayo me with pikin, if i con gentle, say that one mean say tribal marks join my gentility.
she con meet say she get belle, ehn fine you don get belle, i don turn sir alex be that. how come you belle no dey show after months, shay you dey use stomach slimmer Tea ni abi you put am inside bottle.
You con dey beg me say you dey try test my love, that pikin you go born am in the next 4 month o, i no wan hear.
Ladies, no dey try that shit o. if you no want wahala for your life, na beg i dey beg.
No turn us to mumu.